Corruption News

Iranian couple gbab 10-years jail sentence for dancing

0

Dancing couple in Tehran

One Iranian couple for dia 20s don dey sentenced to 10 years imprisonment afta dem post video wey show as dem dey dance for street.

Dem find dem guilty of promoting corruption, prostitution and propaganda.

Di video show as dem dey dance by Tehran Azadi (Freedom) Tower.

Authorities dey give heavy sentences to pipo dem see say dey involved for di protests wey happun afta di death of one woman wey morality police detain.

Di couple no link dia dance to di ongoing protests for Iran.

One source confam to BBC Monitoring say di couple arrest come afta di couple post di video to dia Instagram accounts, wey get combined following of nearly two million.

Anti-government protests – wey Iran regime bin label as “riots” by Iran’s regime – bin sweep across di kontri afta 22-year-old Mahsa Amini, die for police custody for September last year. Dem bin arrest her for Tehran on top accuse say she allegedly violate di rule wey require women to cover dia hair wit hijab or headscarf.

Wetin we call dis Video,

Watch: Iranian couple dance in Tehran streets

Reports say 21 year old Astiazh Haqiqi and her fiance Amir Mohammad Ahmadi wey be 22 year-old dey convicted of “promoting corruption and prostitution, colluding against national security plus propaganda against di establishment”.

Dem bin raid di family home of Ms Haqiqi, wey list her profession as a fashion designer before di arrest.

E neva clear how long di sentence be for each of di separate convictions dem dey face. Dem don sentence each of dem to a total of 10 and a half years – combined sentence for di charges.

If di court ruling stand, dem go serve di longest one of those sentencing terms.

According to reports, dem also dey banned for two-year ban on using social media and leaving di kontri.

Iran protests

Iran protest movement wey start for September don become one of di most serious challenges to di Iranian regime since e come to power for di 1979 revolution.

To quench di protests, di state don dey hand out severe sentences to pipo wey dey involved for di unrest, including executing at least four protesters. earlier dis month and for December.

While Mahsa Amini death na di catalyst for wider unrest for Iran, di long-standing discontent over poverty, unemployment, inequality, injustice and corruption na also some reasons for di unrest.

Hundreds of pipo don die and thousands bin dey arrested during demonstrations over di circumstances of her death.


Source link

Leave A Reply

Your email address will not be published.